fbpx
May 18, 2024

“Don’t Push Me to Expose What You Do” – Popular Cele Prophet, Gabriel Evans Reply Pastor David Ibiyeomie

prophet-gabriel-confront-ibiyeomie

Prophet Gabriel Evans of di Celestial Church of Christ don confront David Ibiyeomie, Senior Pastor of Salvation Ministries, wey confess say hin no like white garment churches.

During di service, di televangelist yarn say hin no like dat particular denomination because of dia worship style.

Ibiyeomie warn hin congregation say if pipo know wetin dem dey do for dia churches, dem no go like Celestial Church of Christ.

In reaction, Evans accuse am say hin don divert from Jesus’ message wey be “love”, hin mention say di word “hate” no suppose come out from pastor mouth.

 

FOR MORE NEW: “Dis one dey give me goosebumps”- Tonto Dikeh hail Pastor Jerry Eze

 

Also, hin yarn say dem no categorised Pentecostal churches as frauds with the actions of some of dia pastors, but he no wan dey forced to reveal wetin hin know about clergymen like Ibiyeomie dey do for secret.

Di white garment church cleric still tok say 80 percent of Ibiyeomie church members bin dey attend white garment church before, while 70 percent of them still dey come back for miracles.

You fit go read di tori as Prophet Gabriel confront Ibiyeomie…READ MORE