fbpx
May 15, 2024

Raheem: Punish killer cop or… Falz dey warn Sanwo-Olu, police

Falz-Sanwo-olu

Nigeria rapper and activist, Folarin Falana wey dey known as Falz, don warn di Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu and di Nigerian Police Force say if dem no punish di policeman wey dey responsible for di killing of di Lagos based lawyer, Omobolanle Raheem e go cause big wahala.

E dey reported say Omobolanle bin dey with some family members on Christmas Day and bin wan try make a U-turn under di Ajah Bridge when di police, an Assistant Superintendent of Police, Drambi Vandi, shoot towards di direction wey her car dey.

Di IGP on Wednesday order di suspension  of di ASP in question.

FOR MORE NEWS: Lagos govt don call night clubs attention on illegal parking

Falz react to di development on Wednesday evening after di suspension of di ASP. For hin tweet, hin write say dem better reveal justice for di case.

Falz, wey be lawyer too reference di #EndSARS protest of 2020. Hin write how dem bin treat young Nigerians because dem dey protest against police brutality. As hin write that one finish, hin note am say nothing don change.

You fit go read di full tori…READ MORE