fbpx
May 5, 2024

One man collapse, as hin dey buy fuel for Oyo

Man-kpai-for-ful-station-for-Oyo-State-

Commotion bin dey di fuel station for Oluyole Estate, Oluyole Local Government Area of Oyo State, when one man wey neva dey identified kpai. Hin bin dey for queue dey wait for hin turn to buy fuel on Thursday, December 29.

According to reports, other motorists wey bin dey rush to buy di product notice wetin dey happen when dem see say di man no fit move hin car as di queue dey move.

Di deceased rest hin head on top di steering of hin car with registration number AKD 878 GP. Pipo bin think say hin dy sleep. Motorists wey dey hin back press dia car horns to alert am make hin move forward but dem no see any movement. That one kon make dem come down from dia vehicles so that dem go ‘wake am up.’ Na for there dem discover say di man don kpai.

Di victim car dey for di nearest police station, while hin corpse don dey deposited for mortuary.

Di state police command neva comment on this development.

You go like read di full tori…READ MORE