fbpx
May 8, 2024

Real Madrid and Bayern Munich qualify, Man United shock as dem no qualify.

Real Madrid and Bayern Munich na some of di clubs wey qualify for di last 16 of di Champions League with two group games to spare on Wednesday, but Man United fall hand as dem lose 4-3 against FC Copenhagen.

Inter Milan, wey be last season’s runners-up, and Real Sociedad also confirm dia tickets for the knockout stage. Dem join Man City wey be di holders, and RB Leipzig wey don advance to the last 16.

Madrid, wey get record 14 European titles, make sure say dem qualify from Group C with 3-0 win against Braga afta one injury wahala just before kick-off. Goalkeeper Kepa Arrizabalaga no fit play because e dey injured for warm-up, but e replacement Andriy Lunin shine as e save Alvaro Djalo penalty wey dem give Braga for di 6th minute.

With Jude Bellingham no dey di team, Brahim Diaz give Real Madrid 27th-minute goal before Brazilian duo Vinicius Junior and Rodrygo score for di second half.

 

FOR MORE NEWS: NPFL: Benue government don yan Lobi Stars say dem go give dem more support.

 

Napoli dey on track to qualify from di group alongside Real Madrid despite dia 1-1 draw for house against Union Berlin. Matteo Politano score Napoli goal for first half, but David Datro Fofana, wey dem loan from Chelsea, equalize shortly after di match restart.

Di result allow Union Berlin to end dia 12-match losing run but dem no fit qualify for di last 16.

Bayern Munich wey be Bundesliga rivals for Union Berlin, qualify with 2-1 win for house against Galatasaray. Na dia 17th consecutive win for di Champions League group stage.

Thomas Tuchel’s team see Galatasaray get goal wey dem cancel because of offside before Harry Kane use head score di opener with just 10 minutes left.

Real Madrid and Bayern Munich don qualify for di last 16 of di Champions League….READ MORE