fbpx
May 8, 2024

EPL: ‘E be warrior’ – Piers Morgan hail Arsenal midfielder.

piers-morgan-hail-arsenal-midfielder

British broadcaster, Piers Morgan don hail Arsenal midfielder Declan Rice for im strong mentality as Gunners knack Burnley 3-1 for Premier League match over di weekend.

Morgan talk say Rice handle one bad challenge from one Burnley player during di match for Emirates Stadium well. During di challenge, Rice no make noise, e just stand up sharply and show thumbs-up to di referee.

However, Morgan, wey be die-hard Arsenal fan, carry the mata go hin X (wey be former Twitter) account to single out England international Declan Rice for im attitude, hail am as ‘warrior’.

 

FOR MORE NEWS: Real Madrid and Bayern Munich qualify, Man United shock as dem no qualify.

 

“Declan Rice just chop foul, jump up immediately, do thumbs up for di ref (wey book di Burnley player anyway), and continue with di game despite say e dey obvious pain.

“E be real warrior. @_DeclanRice #afc.” Morgan write.

“Meanwhile, goals from Leandro Trossard, William Saliba, and Oleksandr Zinchenko give Arsenal the victory over Burnley.”

You fit go read di tori see why Piers Morgan hail Arsenal midfielder…READ MORE