fbpx
May 5, 2024

Destiny Kids’ Rejoice Iwueze and husband welcome first child

rejoice-iwueze-announce-baby-arrival

One of di members of the Destiny Kids’ gospel music group, Rejoice Iwueze, and her husband don announce di arrival of dia first baby.

Congratulations don flood in for di gospel singer wey share di joyful news on top her Instagram page on Sunday. Also, she share photos from her maternity photoshoot.

Rejoice Iwueze wey announce dia baby arrival yarn say dem don level up from being couple to parents and she express her belief in God faithfulness.

 

FOR MORE NEWS: Spyro prostrate as hin meet Wande Coal, netizens react

 

“Leveled up from just being a couple to being parents…God can be trusted. Welcome to the new level baby,” Na wetin she write be dat.

Although dem neva reveal weda na girl or boy she born, but dat one no stop fans and well-wishers from congratulating di couple.

You fit go read di tori…READ MORE