fbpx
May 5, 2024

Spyro prostrate as hin meet Wande Coal, netizens react

spyro-prostrate-for-wande-coal

Veteran Nigerian singer, Wande Coal don make pipo dey tok as one up-and-coming singer, Spyro prostrate for am as dem see dia sef.

During one recent event for di United States of America, di ‘Who’s Your Guy’ crooner lie down flat for ground as hin see Wande Coal as a form of cultural greeting.

However, based on how Wande Coal react, person go know say hin no dey comfortable as hin di singer dey prostrate for am. Also, hin tell di singer say make hin stand up.

If you watch di video, you go hear as hin dey encourage one person for background say make hin no record di scene even as hin dey insist say e no dey necessary.

However, di voice for di background insist say Wande Coal na veteran artiste for di entertainment industry and no be big deal if hin dey receive respect from person like Spyro.

 

FOR MORE NEWS: 2023 Headies: “Nobody fail me, I fail myself” — Portable

 

See how netizens react as Spyro prostrate for Wande Coal

maryvenia said: “Deep down you sure say him wan do am,Abi he just dey … 😂”

tenovertenautos penned: “Onye fe eze, eze eruo ya aka… just a well trained African child respecting the elders that’s walked the path he dreams to walk one day. 🙏🙏.”

ogthehustla stated: “Everyone is pretending.”

vitamin_tomi stated: “When you have God you will be automatically humble ..those screaming eye service heal 🤨they are not mates”

sagiator_ewean_gabriel added: “When u see that ur mentor.”

You fit go read di tori…READ MORE