fbpx
May 6, 2024

Police dey investigate as woman try sell pikin for Rivers

rivers-police-investigate-woman

Rivers State Police Command don talk say dem dey investigate one tori wey dey ground say one woman wan sell her five-year-old pikin for Port Harcourt.

Our person wey waka go di place where di tori happun gather say di woman wey dem call Onyinye carry di pikin go one popular market for Bishop Okoye Street for Mile 3 area of Port Harcourt on Saturday.

Na so katakata start when some traders jam di woman and find out wetin she dey plan wey she talk say na because of suffer she dey reason.

The traders wey no believe say di pikin na her own come bundle di woman and carry her go police station go report di matter, and na so dem arrest her.

 

FOR MORE NEWS: NLC members don set for national protests.

 

One of di traders talk say, “Di way wey I see di woman, I no think say she dey okay because of how she dey act.”

When our person call di police spokesperson for di state on Monday, Grace Iringe-Koko, she confirm di matter talk say dem dey investigate am.

She yan, “Dem carry di woman come station say she wan sell her pikin for market. We dey investigate di matter to know if wetin di people wey see am talk na true. But for now, di woman dey with police.”

People dey talk about dis tori well well as dem dey wonder wetin fit make person wan sell im pikin. But as e dey so, police dey look the matter well well.

You fit go read di tori see why Rivers Police investigate woman…READ MORE