fbpx
May 6, 2024

Tinubu Visit Fit Cause Serious Traffic for Lagos

gridlock-as-tinubu-visit-lagos

Gridlock don hold for Lagos as President Bola Tinubu dey visit di state today. Dis wahala dey come as traffic don already dey for road wey dey go Lagos Island and other places wey connect am after dem close Third Mainland Bridge for repairs.

Also, people wey sidon for house on Wednesday to avoid Third Mainland Bridge because of the repair, still chop traffic for other roads wey dey close to am.

According to di statement wey Federal Controller of Works for Lagos State, Olukorede Kesha sign on Monday, di closure wey start from noon on Wednesday, February 28, go reach noon today, Thursday, February 29, 2024.

Lagos Metropolitan Area Transport Authority talk for their Twitter handle, @Lamataonline, say President Tinubu dey come unveil Red Rail Line.

 

FOR MORE NEWS: Portable tell EFCC say no be all youth dey do yahoo.

 

“Lagos dey buzz with preparations as President dey come visit for di launch of Red Line rail infrastructure,” na so their post talk.

Lagos State Governor, Babjide Sanwo-Olu, don do test-run for Lagos Red Line before di unveiling. E check di tracks, rail corridors, and other facilities like cooling systems, handrails, seats, and safety features.

Also, Sanwo-Olu wey write for im Twitter handle, say, “Red Line Rail Project wey I put ground for April 15, 2021, na big step for connected and sustainable Lagos.

“People dey excited as we dey prepare for di commissioning of di project by Mr President, Asiwaju Bola Tinubu, GCFR, on February 29, 2024.

You fit go read di tori about Gridlock wey fit happen as Tinubu visit Lagos today…READ MORE