fbpx
May 19, 2024

Rivers government shut down AIT, Raypower operations

rivers-shut-down-raypower-fm

Rivers State Government don shut down di Africa Independent Television, AIT, and Raypower FM operations for Port Harcourt.

Di media organization on dia official X on Sunday, announce say di State Government shut down dia operations through contracted telecommunications engineers accompanied by armed security operatives.

Dem tok say di contractors disconnect di wave guard from di antenna on top di mast, and some other riggers bin dey dismantle di mast.

 

FOR MORE NEWS: “Una arrest 100 Gays put for One Cell, No Be Honeymoon Be That?” – Kevin Ikeduba Ask Police

 

Also, dem send bulldozers go di place demolish di Transmitter Complex for DAAR Communications PLC Broadcast Centre.

Di telecommunications’ contractor’s official tell di organization say dem dey work on a directive from above to commence demolition on Sunday.

According to reports, di State government in March bin don already give 48-hours quit notice to DAAR Communication Plc. Also, dem tok  say di area dey mapped out for GRA phase 5 Ozuoba

You fit go read di tori see why Rivers Government shut down Raypower FM…READ MORE