fbpx
May 18, 2024

Cristiano Ronaldo don break silence on claims of hin break up with Georgina Rodriguez

ronaldo-don-react-to-rumours-of-claims-about-hin-relationship

Al-Nassr superstar, Cristiano Ronaldo don react to rumours wey dey spread about a possible break up with hin partner, Georgina Rodriguez.

Di Portugal international don try to bury di rumours around hin relationship with di Argentine-Spanish model as hin post romantic snap on top hin Instagram handle.

Inside photo wey hin share on top Instagram on Sunday, di football icon and Rodriguez bin lock lips as dem dey enjoying food for restaurant.

 

FOR MORE NEWS: EPL: Arsenal to sign ex-Chelsea player for Arteta

 

Hin write, “Cheers to love.”

Miss Rodriguez na di first to dismiss claims say her relationship with Ronaldo go soon scatter.

Di model write, “The envious invents the rumour. The gossiper spreads it.”

Ronaldo and Rodriguez be partners since 2017 and other reports claim say dem fit married within di next ten years.

You fit go read di tori of wetin dey happen as Ronaldo don react to di rumours…READ MORE