fbpx
March 19, 2024

US don ignore Russia warning on arms as Biden meets Scholz

russia-warning-biden-host-scholz

Di United States on Friday don respond to Russia warning against arming Ukraine by offering $400 million for security assistance, as President Joe Biden host German Chancellor Olaf Scholz for show of unity against Moscow.olaf scolz

Meanwhile di head of Russia Wagner mercenary group yarn say dia forces don “practically encircle” di eastern Ukraine city of Bakhmut, wey don see di most damaging fighting of Moscow invasion.Western military aid for Ukraine dey on key to Kyiv ability to hold out against Moscow military onslaught and to even regain ground, but di  Kremlin yarn say dat kain assistance go only “prolong di conflict and e go get sad consequences for di Ukrainian pipo.”

According to Kremlin spokesman Dmitry Peskov, di arms deliveries follow “place significant burden on di economies of di kontri and e negatively affect di well-being of citizens of di kontri, including Germany”.

FOR MORE NEWS: EPL: Even your supporters know you can’t win title – Wayne Bridge dey mock Arsenal

Washington ignore di warning, and dem announce di new security package for Kyiv wey feature ammunition, for di Himars precision rocket system wey Ukrainian forces don use against Russian troops and supply dumps.

For display of partnership after friction over supplying tanks to Ukraine, Biden host Scholz fo di White House for hin first trip to Washington since Russia invasion.

According to Biden tok for brief remarks to the press, di last time wey dem meet, “Russia dey gather troops” for border. Hin add say di West bin vow to respond and “together dem make good on dat promise.”

You fit go read di full tori as US ignore Russia warning on arms and Biden meet Scholz…READ MORE