fbpx
April 26, 2024

EPL: Even your supporters know you can’t win title – Wayne Bridge dey mock Arsenal

wayne-bridge-mock-arsenal

Former Chelsea and Manchester City defender Wayne Bridge mock Arsenal say dem no stand chance of winning di Premier League dis season.

According to di former Blues defender Wayne Bridge mock Arsenal, he yarn say even Arsenal fans ‘know’ say dia team no go fit get dia hands on di Premier League title.

Arsenal dey currently lead di race with five points ahead of Manchester City with 13 games wey remain make dem play.

Di Gunners go play a lowly-rated Bournemouth for di  Emirates Stadium on Saturday, as dem win 19 of dia 25 league games.

FOR MORE NEWS: Naira redesign: Uncertainty as Supreme Court don nullify policy

Mikel Arteta dey hope to guide Arsenal to win di Premier League for di first time since 2004.

But Bridge no see am as something wey go happen. Hin insist say na only matter of time before di North London side make mistake for di title race.

“I think Manchester City will do it and get the title,” di 42-year-old tell JOE’s YouTube channel.

In addition, hin yarn say everybody dey wait for Arsenal mistake. Also, hin think say even dia fans knowsay dem go make mistake at some point.

However, hin say for am, e don see am say na wetin go happenbe dat.

You fit go read di full tori…READ MORE