fbpx
May 3, 2024

“Why I Dump All My Ex-Girlfriends” – DJ Cuppy Ex-boyfriend, Ryan Taylor

ryan-taylor-cause-kasala-online

Popular British boxer, Ryan Taylor, don cause kasala online as people dey yan about why he break up with im former girlfriends, including DJ Cuppy.

This talk carry weight as dem dey talk say the two of dem don separate, even though people talk say dem don engage.

For one Instagram post wey e later delete, Taylor bin ask im followers to yan something about im ex. One pesin yan say, ‘She dey learn how to drift now.’

In response, the boxer talk why e break up with im former girlfriends, e write say, “All my exes no sabi drive, na im make I waka comot for their matter.

 

FOR MORE NEWS: Kenya Flood: Minister talk say di death toll don rise reach at least 120.

 

Di statement wey e make don raise eyebrows as pipo dey ask if e mean say their driving skills bin dey para or if e get any oda serious reason why e waka comot. Wetin dey clear be say dis tok don carry weight for social media as pipo dey talk about di relationship wahala between am and DJ Cuppy.

E no sure if e na playful comment or if Ryan dey yan serious matter, but dis latest talk don carry di mata enter spotlight again, and fans dey follow di gist enta.

You fit go read di tori see as Ryan Taylor cause kasala online…READ MORE