fbpx
April 27, 2024

Senate tussle: Akpabio go appeal judgement

0
Godswill-Akpabio-appeal

Di Court of Appeal, Abuja Division, don grant leave to Senator Godswill Akpabio as an interested party to appeal di judgement of di court wey order di Independent National Electoral Commission make dem delete hin name as di duly elected candidate of di All Progressives Congress for Akwa Ibom North-West (Ikot Ekpene) Senatorial District and make dem replace am with DIG Udom Ekpoudom (retd.).

YOU GO LIKE READ: 11 Home Safety Tips to Keep Your Family Safe

This update dey for statement issued by Senator Godswill Akpabio Chief Press secretary Mr.Jackson Udom, for Uyo, Akwa Ibom State, on Wednesday.

Di Court of appeal on Monday, November 14, 2022, for di Appeal wey Ekpoudom carry come against di APC and INEC, don declared say Ekpoudom be di candidate of di APC for Akwa Ibom North-West (Ikot Ekpene) Senatorial District for di 2023 elections.

This tori dey inside Punch…READ MORE

For more news: Nigeria never ripe for BVAS, IReV – APC chair, Adamu

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *