fbpx
April 26, 2024

Naira Redesign: Disclose how you’re obeying Supreme Court orders – SERAP don tell Buhari

serap-don-appeal-to-buhari-on-supreme-court-order

Socio-Economic Rights and Accountability Project SERAP don appeal to President Muhammadu Buhari on Supreme Court orders . Dem tell am make hin open up on di details of di measures wey hin government dey take to effectively obey di Supreme Court decision. Dis na an di court extend di validity of di old N200, N500, and N1,000 notes.

SERAP again advise Buhari “make hin disclose di measures wey hin government dey take to direct di Central Bank of Nigeria (CBN) to immediately re-circulate di Naira notes, as apex supreme court don order.

For inside di letter wey dem date on Saturday and wey dey signed by SERAP deputy director Kolawole Oluwadare, na wetin di organization yarn be dis “There is an overriding public interest in disclosing the details of the measures your government and the CBN are taking to effectively and satisfactorily obey the Supreme Court decision.

FOR MORE NEWS: Business owners, churches no gree collect old Naira notes for Kaduna

Hin yarn say make dem no put di public for darkness on wetin di government and di CBN dey do to implement di decision. Also, if dem publish di implementation measures, e go improve accountability of state officials. Even di public confidence for rule of law and Nigeria democracy go improve.

Remember say di Supreme Court last week bin extend di validity of di old Naira notes until 31 December.

Di apex court yarn say di CBN must continue to receive di old Naira notes from Nigerians.

Also, di Court hold say Buhari instruction on di redesign of di new Naira notes without due consultation dey illegal.

You fit go read di full tori…READ MORE