fbpx
December 23, 2024

I no support Tinubu to see dis madness – Seyi Law

seyi-law-don-express-anger

Comedian Oluwaseyitan Aletile, wey dey known as Seyi Law, don express anger for di ongoing ‘Yoruba for Yoruba jobs’ protest for Southwest states.

According to report, Tonia Somaga, a graduate from Anambra State and a Labour Party, LP, supporter wey drive one of di Lagos State blue rails, bin dey called out by some residents. Also, dem advise di Lagos State government make hin sack her, following her campaign for Peter Obi.

Reacting to di development inside tweet on Thursday, Seyi Law yarn say di female train driver na opportunity to preach peace and show say All Progressives Congress, APC, dey different.

As hin share picture of a man with  ‘Yoruba Jobs for Yoruba People’ poster, Seyi Law describe di trend as absolute madness. Also, hin insist say hin no support di President-elect, Bola Tinubu, to see dat kain trend.

FOR MORE NEWS: Elon Musk don remove Davido, Wizkid, Burna Boy, and others verification badges

He wrote: “This is absolute madness. I did not support ASIWAJU to see these things. Are you saying even the companies owned by non-Yoruba should do the same, or just those owned by Yorubas? Either way, this is wrong, so let’s stop promoting rubbish in the name of anger.

In addition, as Seyi Law express hin anger, hin yarn say di attitudes give bad names to good ideas. And dem must do wetin dey right to say dem deserve more.

“Please, I believe we can do better. Things are tending in a direction I don’t appreciate. This doesn’t in any way dim my support for the good I believe ASIWAJU will bring. Thanks.” Na wetin hin tok be dat.

You fit go read di tori…READ MORE