fbpx
June 17, 2024

Shanty Town: “Naked Scenes Bin Dey Inevitable” – Ini Edo Don Tok

shanty-town-naked-scenes-Ini-Edo-don-reveal-why-e-dey-inevitable-

Actress, Ini Edo don reveal why naked scenes bin dey inevitable for di trending movie series, Shanty Town.

Di actress make her point clear for interview wey she do with BBC Pidgin. She tok why dem show some private body parts for di film.

According to Ini Edo wey play di role of ‘Inem’, Shanty Town na story about crime and prostitution and nobody go fit tell di story without showing nakedness, na why dem show naked scenes.

FOR MORE NEWS: Celebrities don attack Nedu over hin comment about BBNaija female housemates

She add say as dem show naked scenes for di film, no be to devalue anybody but di reason na to make di movie look real.

Di veteran movie star also criticize di tok wey pipo just dey carry up and down about di woman body wey dem see. She kon advise pipo say make dem no look am as woman body buy make dem look am as creation of God without and reasonings attached.

You fit go read di full tori…READ MORE