fbpx
April 29, 2024

Shehu Sani don caution pipo wey dey refer to di President-elect, Bola Tinubu as drug baron

shehu-sani-don-caution-pipo-on-di-drug-baron-tok-

Former Senator representing Kaduna Central Senatorial District, Shehu Sani, don caution pipo wey dey refer to di President-elect, Asiwaju Bola Ahmed Tinubu as drug baron.

Shehu Sani caution pipo as hin write for hin Facebook wall on Tuesday say nothing dey wrong with criticising di President-elect, and say huge implications dey if pipo continue to refer to am as drug baron.

For di post, hin dey try explain say dat word go affect di all citizens of di kontri.

FOR MORE NEWS: Election result: Allow cameras at hearing – Joe Keshi don charge Supreme Court

According to wetin hin tok, nothing dey wrong with criticising Tinubu and questioning hin election victory. However, hin tok say he must caution on di implication of continuously referring to am as drug baron.

Also, hin tok say as a President-elect of our kontri, such tag go dey stigmatised on you and me as citizens, especially from foreign perspective or when we travel out of di kontri.

In addition, hin yarn say make pipo allow dat drug matter  rest. Also, he yarn say di matter  don settle since. He finally add sayt make dem pick am up on any other issues responsibly. Na wetin hin write be dat.

You fit go read di full tori…READ MORE