fbpx
May 4, 2024

Atiku, Peter Obi vs Tinubu: Wetin go happen if tribunal sack president – Shehu Sani

shehu-sani-predict-tribunal-rule

One former Kaduna Central Senator, Shehu Sani, don predict wetin fit happen to President Bola Tinubu if di presidential election tribunal rule against am.

Sani tok say na only God go save Tinubu from di mouth of one  “Kaduna emperor” if di tribunal sack am.

On Monday, di Appeal Court fix today, Wednesday, for di ruling on di petition against Tinubu victory.

However, Sani yarn say di opposition fit congratulate am if di tribunal confirm hin victory.

 

FOR MORE NEWS: Tight security as Presidential Election Petition Court deliver judgment

 

For inside hin tweet, hin yarn say di “Kaduna emperor” go criticise Tinubu for hin next book.

Presidential candidates of di Peoples Democratic Party, PDP, Atiku Abubakar and Labour Party, LP, Peter Obi, dey challenge Tinubu victory.

Dem accuse di Independent National Electoral Commission, INEC, of declaring Tinubu di winner of di presidential election when hin no poll enough votes.

You fit go read di tori see wetin Shehu Sani predict as tribunal rule..READ MORE