fbpx
May 5, 2024

Tight security as Presidential Election Petition Court deliver judgment

tight-security-for-petition-court-as-court-deliver-judgement

Tight security dey for di Court of Appeal Complex wey dey di Three Arms Zone, Shehu Shagari Way, Central Business District of Abuja, as di Presidential Election Petition Court dey prepare to deliver judgment.

Di News Agency of Nigeria (NAN) give reports say di judgment dey in three cases wey dey challenge di outcome of di Feb.25 presidential election.

Dis matter dey come about a month after di court hear di closing arguments of parties to di petitions. And na two weeks remain for di expiration of di statutory 180-day lifespans.  And from within di time wey dem file di case in March, e don reach time make di judge decide on wetin go happen.

Also, di five-member panel of di court headed by Haruna Tsammani bin reserve judgements on di petitions after hin hear di closing arguments of di parties to di cases in early August.

 

FOR MORE NEWS: Election Tribunal: Vice President Shettima, governors, Ganduje don enter court

 

In addition, NAN reports say plenty security operatives don cover all di roads wey lead to di Court of Appeal complex. Also, di security operatives come from difference arms, including di armed forces, police, men of di Department of State Services (DSS) and di Civil Defence.

Also, di same formation dey ground within di court complex.

Di Chief Registrar of di Court, Mr Umar Bangari, inside statement on Monday, yarn say everything dey in place to make sure say di Judge go deliver di judgment for di three pending petitions without any wahala.

In addition, Bangari tok say better tight security for di petition Court dey ground and na only di invited members of political parties and general public na hin dem go allow to enter di courtroom.

You fit go read di tori…READ MORE