fbpx
May 9, 2024

Election Tribunal: Vice President Shettima, governors, Ganduje don enter court

shetima-don-enter-petition-tribunal

Vice president, Kashim Shetima, Bauchi State governor, Bala Mohammed, Nasarawa State counterpart, Abdullahi Sule don enter di Presidential Election Petition Tribunal to witness delivery of judgment for di petitions wey dey challenge Bola Tinubu as winner of di  2023 presidential election.

Shetima, wear white agbada with multi-coloured cap to match, and staff of security operative follow am go di courtroom.

Also, di other pipo wey dey inside di courtroom na Imo State governor, Hope Uzodinma, Kogi State governor, Yahaya Bello, former Zamfara State governor, now Minister of State for defense, Bello Matawale and APC National Chairman, Abdullahi Ganduje.

 

FOR MORE NEWS: Anti-bomb experts don take over Presidential Election Petition courtroom

 

Ekiti State governor, Biodun Oyebanji, Chief of Staff to di President, Femi Gbajabiamila, Maimala Buni follow dey inside di court.

Di Vice President enter di courtroom with some APC supporters wey qualify to witness delivery of di judgment.

Lawyers to di PDP presidential candidate, Abubakar Atiku, led by Chief Chris Uche, SAN, don follow reach di courtroom.

You fit go read di tori see wetin dey happen as Shetima don enter di Petition Tribunal…READ MORE