fbpx
May 9, 2024

President Election Court: Atiku, Obi still dey fight, Tinubu, and others hail judgement

controversies-still-dey-follow-wednesday-judgement-

Wednesday judgement of di Presidential Election Petition Court no go mark di end of di controversies wey dey follow di outcome of di 2023 presidential election.

Di five-man panel, inside final judgement wey Justice Haruna Simon Tsammani read, bin strike out di three petitions wey di Peoples Democratic Party, PDP, Labour Party, LP, and di Allied Peoples Movement, APM file.

Also, di Tribunal don settle all di matter against di petitioners in favour of di respondents, President Tinubu, his Vice, Kashim Shettima and the APC.

Even as di APM neva tok dia next line of action, both di PDP and the LP candidates, Abubakar Atiku and Peter Obi, respectively, don vow say dem go challenge di judgement for di Supreme Court.

Dem make dia decisions know to di public on Wednesday shortly after di Tribunal pronounce say dia petitions dey dismissed.

 

FOR MORE NEWS: Commotion as police tear gas for protesting UNILAG students

 

However, for di All Progressives Congress, APC, President Bola Ahmed Tinubu and former President, Muhammadu Buhari, na victory wey dem don dey expect and na true reflection of di wishes of di pipo.

Tinubu and hin party receive praises as di Tribunal uphold hin election.

But for di camp of di PDP and di LP, na clear miscarriage of justice.

Also, di two of dem don vow to challenge di judgement for di Supreme Court.

Uche tell newsmen say Atiku collect judgement from di Tribunal but hin no get justice, and na why hin go appeal.

Likewise, Livy Uzoukwu, SAN, di lead counsel to Obi confirm say hin client don give order make dem carry di matter go Supreme Court.

He wonder why di Tribunal, wey rule against live telecast of proceedings, suddenly allow live coverage of di judgement.

You fit go read di tori…READ MORE