fbpx
May 18, 2024

No post corps members go Zamfara, Kebbi, Sokoto – Shinkafi caution NYSC

shinkafi-don-advise-nysc

Former chairman of di Committee on Prosecution of Bandits Related Offences for Zamfara State, Sani Shinkafi don advise di National Youth Service Corps, NYSC, say make dem no dey send corps members to some States for di northern part of di kontri.

Hin warn dem about di plan against sending corps members to States wey bandit dey always attack.

Shinkafi list States like Zamfara, Kebbi and Sokoto.

Hin give di warning two weeks after arm bandits kidnap about eight members of di National Youth Service Corps along highway for Zamfara State.

Shinkafi bin dey on top Channels Television breakfast programme, Sunrise Daily, when hin make di call.

“I’m calling on the leadership of NYSC to stop posting youth corps members to Sokoto, Kebbi, and even Zamfara.” Na wetin hin tok be dat.

 

FOR MORE NEWS: Enugu govt go raise LG funds by 60 per cent

 

As hin dey tok, hin publicly criticize di Zamfara State Governor, Dauda Lawal, because di man no gree engage in “peace dialogue” with repentant bandits.

However, according to am, di stance wey di former Governor of di State, Bello Matawalle take, to dialogue with terrorists bin dey beneficial.

Also, to conclude hin tok, Shinkafi don advise NYSC,  and hin yarn say no place for Zamfarawa state dey safe.

You fit go read di tori…READ MORE