fbpx
May 18, 2024

We no accept dishonesty for our household — Celebrity couple, Adekunle Gold and Simi reveal

simi-no-condone-dishonesty

Popular Nigerian singer, and celebrity couple, Adekunle Gold, and hin wife, Simi, don reveal say dem no dey condone dishonesty for dia household.

Di celebrity couple, wey tied di knot in 2019 and welcome dia first pikin, Adejare, in 2020, tok dis one as dem dey play viral TikTok couple game where dem respond to computer-generated questions.

As dem see question of wey ask say who dey more dishonest between di two of them, dem find am hard to answer. Simi finally mention say dishonesty no be something wey dem dey tolerate for dia household.

In response to another question on wetin make dem envious of one another, Simi yarn say she dey envious of her husband free time because she no get enough free time. Adekunle, on hin part, tok say hin envy how Simi no dey worry about anything.

 

FOR MORE NEWS: Yvonne Jegede mark 40th birthday with ageless photos

 

Also, Adekunle, 36, and Simi, 35, reveal say di two of dem dey very smart and intelligent, in response to question on if dem dey as smart as dem think.

In other news, Simi share how her eyesight kon worse after she born her baby three years ago.

You go remember say di ‘Duduke’ crooner and her singer husband, Adekunle Gold, welcome dia first child, Adejare, in May 2020.

Inside recent video for social media, Simi reveal say her eyesight no remain di same since she get belle born her daughter.

You fit go read di tori see why Simi reveal say dem no condone dishonesty…READ MORE