fbpx
May 18, 2024

Steve Harvey debunk cheating rumors about hin wife

steve-harvey-debunk-cheating-rumors

Ace American TV host, Steve Harvey don debunk di cheating rumors wey dey go round about hin wife, Marjorie Bridges. Di rumors tok say hin wife cheat on am with dia bodyguard and personal chef.

Na for weekend internet hot with di rumors wey tok say Marjorie commit adultery with dia staff, and say she filed for divorce after person catch her redhanded.

According to wetin some report tok, she bin demand for $200m of Steve worth. Na dat matter cause a huge buzz online. Some netizens even come out dey drag Marjorie and others label Steve as man wey dey do like mumu for hin marriage.

 

FOR MORE NEWS: Angry Mob Beat Robbery Suspect To Death For Lagos

 

Well, di 66-year-old host Steve Harvey don come out tok say all di viral cheating rumors na lie, hin debunk di rumors. Hin tok am as hin dey for Invest Fest 2023 for Atlanta on Sunday, August 27.

As Steve dey tok for di event, na wetin hin tok be dis, “Before I get started, just let me say, I’m fine. Marjorie’s fine.’ As hin tok dat one, na so hin wife start to cheer from di audience”.

“I don’t know what y’all doing, but find something else to do ’cause we fine. Lord have mercy. Man,” “I ain’t got no time for rumors and gossip. God’s been good to me, I’m still shining.” Na wetin Harvey tok be dat.

You fit go read di tori…READ MORE