fbpx
March 28, 2024

Stop to dey run to pastors for prayer, engage more in personal prayer – Kumuyi yarn Christians

0

Di General Superintendent of Deeper Christian Life Ministry, Pastor William Kumuyi don advise Christians to reduce di rate wen dem take dey rush to pastors for prayers and instead engage in personal prayer with God.

Hin yarn dis one for one minister’ conference,hin tok say e dey wrong for pipol to shift dia personal responsibility and problems to God through some pastors for divine solutions.

U FIT ALSO READ Power generation don climb up to 4,735.1MW

Hin teach from di book of Exodus 33:1-3, 12-15, Pastor Kumuyi tok say , like Moses, Joshua and Elijah who been dey exhausted yet still create time to hear from God.

As a minister you must wrestle in di presence of God so as to get strength and power to move dia vision.

Kumuyi tok say that on the verge of death, Jesus personally seek di face of his father, therefore, leaders and professionals should also take out time to seek for di face of God.

According to pastor kumuyi “The di situation where people con dey shift personal responsibility of take dia problems to God for a divine solution through dia pastors na wetin no good at all at all.

Hin yarn say We are in a pray-for-me generation.whereby pipol feel say dey cannot live or survive except somebody do am for dem.

Pastor kumuyi tok say: “E dey very important to pray by ourself dan to dey run go meet one pastor to dey look for wetin no lost.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *