fbpx
May 20, 2024

Super Eagles don drop from latest FIFA world ranking

0

Nigerian Super Eagles don drop come down from position wey dem dey for di latest Federation of International Football Federation (FIFA) men’s world ranking.

Di three-time African champions bifore bifore dey for 32 position for FIFA world ranking but now dey don drop come 35 position.

U FIT ALSO READ ‘I no fit believe am’, Messi write after e win World Cup

Jose Peseiro’s side sef don drop from fourth to fifth position for Africa.

Di Atlas Lions of Morocco, Terangha Lions of Senegal, Carthage Eagles of Tunisia and Indomitable Lions of Cameroon all dis African teams dey ahead of di Super Eagles for football ranking.

Super Eagles, bin fail to qualify for di concluded 2022 FIFA World Cup for Qatar, and dey also loose for dia friendly match against Costa Rica and Portugal last month.

Brazil still remain di number one team for di FIFA world ranking despite say dem bin comot for World Cup for quarter-final stage.

Di recent world champions, wey bi Argentina don move to second position for FIFA world ranking.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *