fbpx
May 5, 2024

“My Grammy award Dey Inside Shelf Somewhere” – Tems reveal

tems-mistakenly-reveal-where she-keep-her-grammy-award

Tems, wey be Grammy-winning musician from Nigeria, don mistakenly reveal where she keep her prestigious Grammy award.

Remember say di young artist, Tems receive Grammy Award after she win di ‘Best Melodic Rap Performance’ for her feature on American rapper, Future’s song, Wait for You.

During one interview, Person ask Tems say, for where she keep her Grammy prize for di song “Wait for You,” wey she receive, her comment na, “Maybe inside a shelf somewhere.”

 

FOR MORE NEWS: Rema Ethiopia show don cancel over hin ‘burning church’ necklace

 

Fans and internet users dey talk about her cool response to di honor wey plenty pipo dey chook eye for, and dem tok say e be like how her fellow Nigerian singer Burna Boy for answer. Also, dem underline di fascinating distinctions between the two stars.