fbpx
March 28, 2024

Terror Alert: British airways don resume London-Abuja flight

0
BritishAirways-

Di United Kingdom carrier, British Airways, don resume dia London-Abuja flight BA83 after dem cancel di flight two days. Dem bin don report say di airline cancel dia flight to Abuja on Friday and Saturday 24 hours after dem divert di Abuja-bound flight to Lagos.

Dem bin divert di BA83 flight from London-Heathrow to di Nnamdi Azikiwe International Airport (NAIA), Abuja to Lagos on Thursday.

But di development start to bring different reactions among passengers wey e affect and, the one wey complain say dem no give dem better notice.

YOU GO LIKE READ: How to Educate Yourself on a New Subject

As di matter be sha, di British airways no talk why dem make di decision.

After dem cancel di Abuja-bound flight on Friday and Saturday, di airline don change dia flight schedule for Abuja, and e go start from Sunday (today).

Di Lagos-Abuja flight go dey comot by 0810hrs and e go arrives 1515hrs instead of di previous 22:25hrs and 4:40hrs.

Enter Vanguard go read di remaining tori…READ MORE

For more News: UNILAG go expose students to energy creation, management — VC

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *