fbpx
April 25, 2024

Terrorism: Nigeria dey No 2 upon di N11tn security budget.

0
Buhari\

Naija budget total of N11.18tn for security from 2015 to 2022, investigation by The PUNCH na hin announce this one. Even as the money wey dem budget for security from terrorism plenty like that, Naija never change, e still be di second most attacked country by the Islamic State terrorist group globally, according to the data wey Jihad calculate.

Jihad Analytics dey focus on global and cyber jihad, open-source intelligence and data.

For this report wey cover January to June 2022, the group tok say Naija don record 305 attack with Iraq wey stand as the first (337) and Syria third (142).

All this one dey happen against wetin the President, Major General Muhammadu Buhari (retd) don tok. He bin tok say hin regime dey win di counter-terrorism war.

You fit still like to read this one: Peter Obi Na Deceiver- Dele Alake Yarn Nigerian

The PUNCH don report the activities of ISWAP terrorists and bandits for di North-West, North-Central and attacks for South-West.

The group claim di responsibility for the attack on the Kuje Medium Security Correctional Centre, Abuja, on July 5, when hundreds of Boko Haram suspect, commanders and other criminals wey escape.

Dem believe say him fighters na hin plan di attack on the elite Guards Brigade troops for Abuja wey l five soldiers sef kon kpai.

Since Buhari don enter office on May 29, 2015, his regime don collect up to N11.18tn as security budget.

CLICK HERE make you for see more of this tori.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *