fbpx
April 24, 2024

Tinubu don enter Naija.

0
Tinube-don-return-to-Naija

Mr Tinubu plane enter Abuja international airport on Thursday evening. The Director General of the APC campaign council, Simon Lalong and former National Chairman of the APC, Adams Oshiomhole, na some of the party wey receive am for airport.

The rumor wey dey fly up and down for everywhere be say Tinubu dey sick well and na why hin go London and hin no go come back anytime soon until next year campaign. But as the tori be now, E don talk say nothing do am and hin dey strong.

Otedola’s Power Company don become first (GenCo) to show-face for Nigerian stock market

Hin team claim say hin travel go UK go rest for some time before the campaign start.

For the last few days, people wey dey handle hin social media don share pictures and ‘workout videos as hin opposition wan know where hin dey. The #WhereIsTinubu bin trend for Twitter for days.

The tori full ground, CLICK HERE make you go enjoy more of the tori.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *