fbpx
April 25, 2024

“Tinubu the drug lord” na sign of frustration from opposition– festus Keyamo

0

Di tok tok persin for Tinubu-Shettima Presidential Campaign Council, Festus Keyamo, SAN, don come out tok say dat rumour wen dey spread say Bola Ahmed Tinubu dey into drug trafficking and money laundering case for United States say na lie ooo say na frustration from opposition candidates

Keyamo yarn dis one on Wednesday for hin Twitter account, Keyamo tok say those pipol wen dey tok dat thing no be dia fault oo

U FIT ALSO READ Elect Tinubu secure Nigeria future – APC Professional council dey advise youths

Hin tok say na because say those pipol dey face family problem and family problem fit make human being dey think like fish.

One old judgment document been resurface for di media on Tuesday,wen yarn say tinubu been dey into drug trafficking and money laundering for United States

According to wetin David Hundeyin tok inside one of hin article titled, “Bola Ahmed Tinubu: From Drug Lord To Presidential Candidate”,wen dey try to expose di same matter for 2015 elections, na hin don surface for di media again.

Meanwhile, di allegation say tinubu na drug lord don dey scatter di whole Nigerian social media.and dat kind thing no good at all

To rea di full tori CLICKHERE

.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *