fbpx
May 5, 2024

Tiwa Savage don pass Wizkid, she be second most followed Nigerian celebrity for Instagram.

tiwa-savage-instagram-second-position

Tiwa Savage don carry second position from Wizkid as di Nigerian wey get second highest followers for Instagram. Davido dey number one with 28.2M followers. Wizkid bin dey second until few days wey Tiwa Savage carry beta pass am with 17.9M followers.

Although the gap between Tiwa and Wizkid no too much, fans of Tiwa Savage dey proud say their favorite singer dey lead with over one hundred thousand followers.”

No forget say Grammy Award nominee, Davido Adeleke, dey wear di crown for di most followed Nigerian celebrity with a huge 28.2M followers.

 

FOR MORE NEWS: EPL: ‘E be warrior’ – Piers Morgan hail Arsenal midfielder.

 

Fans dey react to the matter as Tiwa Savage carry second position:

  • fizo_cash talk say: “No be by followers, my Big Wiz still get better engagement pass di person wey get 28M followers sef 😂😂.”
  • official__banana__ yan say: “Person wey get di highest followers for Nigeria sef no get beta achievement 😂😂.”
  • jiggysliit_ allege say: “Tiwa don go buy followers, FC make we buy followers for Wizzy? 😂.”
  • burnaboygram_07 talk say: “Tiwa dey copy dat Frog voice 🐸 wey dey buy followers.”
  • official_dej write: “She never still get endorsements reach BigWiz despite dat. Stop playing

You fit go read di tori…READ MORE