fbpx
May 18, 2024

“Tiwa Savage na hin open way for me” – Ghanaian singer, Amaarae

tiwa-savage-open-way-for-me-Amaarae-claim-about-Tiwa-Savage

Ghanaian-American singer, Ama Serwah Genfi, wey dey professionally known as Amaarae make claim about Tiwa Savage. She yarn say di Nigerian music icon, Tiwa Savage na hin open way for her inside di African music industry.

During interview on top Ghana 3FM 92.7, where Amaarae make claim about Tiwa Savage, she yarn say di ‘All Over’ crooner dey always encourage her.

Amaarae, wey appear on Tiwa Tales By Moonlight, name di Nigerian Singer as one of her favorite collaborators.

FOR MORE NEWS: “This is so embarrassing” – Netizens reacts as actress Nkechi Blessing lover show off her pant for new video

Di singer claim say she admire di former Mavin first lady because of how devout, generous, and modest she be, despite di fact say she be di top female performer for di  music industry.

Also, as she tok say Tiwa Savage open way for her, she claim say Tiwa dey always check on her and her mama.

You fit go read di tori…READ MORE