fbpx
May 18, 2024

“This is so embarrassing” – Netizens reacts as actress Nkechi Blessing lover show off her pant for new video

nkechi-blessing-lover-don-cause-stir-for-internet

Popular Nollywood actress, Nkechi Blessing and her lover don cause stir with new video of dem wey dem post for internet.

Na on top Nkechi lover Xxssive Instagram page, na hin di video dey. Di video show as hin dey hold one animal skin pant and hin announce say di actress dey wear pants now.

Also, e get one time wey di actress ex-lover yarn say she no dey wear pants and she no get good personal hygiene.

Maybe hin dey happy now say hin woman dey wear pants, Xxssive take to social media to share di news with hin fans and followers.

FOR MORE NEWS: I pay crazy money to bail my papa from kidnappers – Mike Obi

In addition, as hin show off di pant, he write, “What God cannot do does not exist 🤗🤗 This calls for thanksgiving 🙏🏾”.

However, di video wey Nkechi Blessing lover share don cause stir and e spark outrage among plenty netizens. Di netizens criticize di actress because she allow her lover disrespect her for dat kain manner.

Plenty pipo express dia disappointment, dem yarn say e dey very unacceptable for a man to show off hin partner undergarments for public.

In reaction to di video, one Instagram user write, “Those laughing at the comment section, abeg how is this stuff funny? I’m trying to laugh, I can’t find anything funny about the video”.

@iamloveth write, “This is so embarrassing 😭😭 no be me Dey video na me catch the shame 😢”.

“This is so silly to watch everything no be cruise… And pls just read and pass my comment No talk Nonsese else you go collect!!!”, another user added.

 

You fit go read di tori…READ MORE