fbpx
May 22, 2024

Presidential Poll Dispute: Atiku don closes case against Tinubu with 27 witnesses

atiku-don-close-hin-case

Former Vice President and candidate of di Peoples Democratic Party, PDP, Atiku Abubakar, wey want make court nullify di election of President Bola Tinubu, on Friday, don close hin case before di Presidential Election Petition Court, PEPC, sitting forAbuja.

Atiku, wey call a total of 27 witnesses, tender documentary exhibits in evidence before di court. Hin yarn say di decision to close hin case dey in view of di fact say hin don use up di days wey dem give am to present his case against Tinubu.

Alo, di Independent National Electoral Commission, INEC, through dia lawyer, Mr. Kemi Pinhero, SAN, tell di court say all di parties wey bin meet before bin agree to delay di opening of defence by di Respondents till after di impending Sallah celebration.

 

FOR MORE NEWS: DSS get power to prosecute cyberstalking – Judge don rule

 

Also, confirming di development, head of President Tinubu legal team, Chief Wole Olanipekun, SAN, beg di court make dem allow di Respondents, start with INEC, to open dia defence to Atiku petition, from July 3.

Following no objection stance by counsel to di Petitioners, di Justice Haruna Tsammani-led five-member panel, adjourn di case till July 3 for INEC to open dia defence to di petition.

 

You fit go read di tori see more gist on why Atiku don close hin case …READ MORE