fbpx
May 5, 2024

I dey kampe – Actor Tony Umez Debunk Death Rumours

tony-umez-deny-death-rumors

Tony Umez, wey be Nollywood actor, don deny di death rumors wey dey fly for internet.

As Tony Umez deny di death rumours for inside hin Instagram page, hin tok say di death rumors wey dey circulate on top social media don cause him, his family, and loved ones pain and dem dey plan to sue di person wey dey share di fake news.

Also, hin tok say hin understand di power of social media and di impact on information wey pipo share. Hin tok say e dey sad to see how some pipo dey abuse am with di fake news wey dem dey promote for personal advantage.

Also, hin advise pipo say make dem dey trust information wey come directly from am or hin official channels,” Na wetin hin write for Facebook be dat.

 

FOR MORE NEWS: “They manhandle me” – Korra Obidi lament over experience with Lagos police

 

November 16th 2022, Nollywood actor, Tony Umez and hin beautiful wife celebrate dia 23rd wedding anniversary.

Di actor take to hin Instagram page to share loved-up photos of himself and hin better half.

Celebrating dia 23rd anniversary, Tony Umez pray make dia union wax stronger.

As hin dey express hin gratitude to hin wife, hin appreciate her as she make am complete.

You fit go read di tori…READ MORE