fbpx
May 6, 2024

Obi go soon dey declared as Nigeria president, Abure tell Nigerians for US

tribunal-go-declare-obi-as-president

Julius Abure, national chairman of di Labour Party (LP), yarn say Tribunal go declare Peter Obi, presidential candidate of di Labour party, as president of Nigeria.

Abure tok dis one as hin dey address some Nigerians for di United States during hin tour for di country.

Obi wey come third for di presidential election wey hold in February and hin party dey challenge di outcome of di poll.

Also, dem dey ask court say make dem nullify di victory of Bola Tinubu, candidate of di All Progressives Congress, APC.

 

FOR MORE NEWS: My biggest dream na to coach Premier League club – Fabregas

 

Abure, wey dey on tour to di United Kingdom and di US, yarn say di judgment by di presidential election petition tribunal, PEPT, dey expected to come on or before September 16. And Tribunal go declare Peter Obi as President of Nigeria.

Following Peter Obi participation for di 2023 general election, hin yarn say dem change di political narratives for Nigeria. Hin yarn say di party give dem a run for dia money.

In addition, hin tok say dem don murder sleep and no go fit sleep again. Also, dem steal wetin no be for dem and dem no go fit sleep until di party don recover everything.

You fit go read di tori…READ MORE