fbpx
May 9, 2024

My biggest dream na to coach Premier League club – Fabregas

fabregas-biggest-coaching-aspiration

Former Arsenal, Barcelona, and Chelsea midfield maestro, Cesc Fabregas, don reveal say hin biggest coaching aspiration na to manage English Premier League club.

Fabregas wey win major trophies during hin footballing career for Spain and England, tok dis matter during di recent exclusive interview with Sky Sports.

Di Spanish legend, wey wan start coaching career for Italy yarn say hin passion for football come back di moment wey hin tok with di team.

 

FOR MORE NEWS: Kano Govt slash tertiary institutions’ fees

 

Also, hin announce hin retirement from playing in July, and hin join Como for coaching assignment.

Hin tok say since hin start coaching, from day one, di fire follow come back.

Fabregas add say di Premier League na di objective; hin yarn say na one of di biggest dream wey any coach fit get.

Also, hin tok say hin believe so much in hin methodology and hin know say na every day person dey learn.

Expectations dey there but na wetin you do and how you manage those expectations na hin be di main thing.

You fit go read di tori see Fabregas coaching aspiration…READ MORE