fbpx
April 27, 2024

US Government Don Tell TikTok Owners Make Dem Sell App Or Face Ban

us-government-to-ban-tiktok

Di United States  US government don threaten to ban TikTok for dia territory if di Chinese parent company, ByteDance no sell dia stake for di U.S. version of di app.

Dis move be like di most dramatic series of escalations by US officials and legislators, wey dey driven by fears say US user data wey di company dey hold fit dey passed on to China government.

Also, dis matter dey come amid di global backlash to di popular video-based app over concerns about di potential for Chinese spying, with other Kontri wey include di UK, Canada and Australia. Dem recently make move to ban di app from government phones.

According to report by Axios, di US don already ban TikTok on top federal government devices but dis one mark di first time under President Joe Biden administration.

Biden predecessor, Donald Trump, bin try ban TikTok in 2020 but court bin block am.

 

Brooke Oberwetter, TikTok spokesperson say make di Chinese owners of di app sell their shares, otherwise de go face possible US ban of the video app.

TikTok na one of di world most popular social networks with more than 100 million US users.

 

According to di Journal, 60% of ByteDance shares dey owned by global investors, 20% by employees and 20% by di founders. CFIUS, a powerful national security body in 2020 bin inanimously recommend say make ByteDance divest TikTok.

FOR MORE NEWS: “Na wetin I go do be dis if Tinubu invite me into hin government” – Peter Obi

TikTok and CFIUS don dey negotiate for more than two years on data security requirements. TikTok yarn say dem done spend more than $1.5bn on rigorous data security efforts and rejects spying allegations.

On Wednesday, TikTok yarn say di best way to address concerns about national security na with di  transparent, US-based protection of US user data and systems, with robust third-party monitoring, vetting, and verification”.

Di news of a potential US ban follow reports this week say Britain dey moving forward with hin own plan to ban TikTok on government cell phones.

You fit go read di full tori…READ MORE