fbpx
May 8, 2024

PDP Chairman don resign for Kogi

kogi-pdp-chairman-don-resign

Di Peoples Democratic Party, PDP, Chairman for Okehi Local Government Area of Kogi State, Mr Adinoyi Aroke don resign from hin party.

According to wetin report tok, di man don dey with PDP since 1998.

Aroke, wey serve as former state financial secretary of di party and as former Special Adviser to former Governor Ibrahim Idris on poverty reduction, submit hin resignation inside letter dated 7th September, 2023, and e dey addressed to di ward chairman of di PDP for Oboreke Eba Ward, Okehi Local Government.

According to Kogi PDP Chairman wey don resign, hin tok say all through di period wey hin serve, hin be loyal and dedicated member of di party since 1998. Also, hin note am say by di letter of resignation wey hin issue to di chairman of PDP, Oboreke Eba, hin membership of di party don come to an end.

 

FOR MORE NEWS: Reactions as Davido tok say hin dey charge $600,000 for one show

 

Okehi na di home local government of Mrs Natasha Akpoti-Uduaghan, di PDP senatorial candidate for di last National Assembly election.

Part of the letter reads: “I hereby write to tender my letter of resignation from the Peoples Democratic Party, PDP, after my loyal and dedicated service to the party since 1998. “With this resignation henceforth, my membership of the party has completely come to an end.

Also, hin tok take hin dey use di opportunity to inform di ever growing, loyal and committed members of hin political family and friends within and outside Kogi State, say hin go make dem know hin next political move after due consultation.”

You fit go read di tori…READ MORE