fbpx
May 8, 2024

Actress Uche Montana splash millions on brand new Range Rover

uche-montana-new-range-rover

Actress, Uche Nwaefuna professionally known as Uche Montana don splash millions of Naira on a brand new Range Rover.

Uche Montana wey don appear for number of movies and series, don join di league of celebrities wey get new Range Rover for di entertainment industry.

A close friend of di ‘Dinner At My Place’ actress take to social media to announce di news of her luxury purchase, while also congratulating her on her latest acquisition.

Di friend post video of di wonder on wheels and she write,

“Congratulations baby. My screen goddess ain’t playing
You worked hard for it. You deserve this and more.”

FOR MORE NEWS: Bobrisky drop N20 million to feed Christians, Muslims wey dey fasting

Nollywood actress and model, Uche Nwaefuna, also known as Uche Montana don address Instagram age setters make dem mind dia respective businesses.

Di pretty diva wey celebrate her birthday a few days ago, yarn say she be 25 years old, however her followers on Instagram dey doubt di age.

But for Uche Montana, she be 25 years old and she dey proud of her age,

“SO FOR THE PAST 3 YEARS .. INSTAGRAM AGE SETTERS WHO APPARENTLY ARE MY LOST MOTHERS AND FATHERS HAVE ARGUED WITH ME ABOUT MY OWN AGE. I TIRE O. I’M 25 AND I’M PROUD OF IT .. WHAT’S THE REASON TO LIE. IF I SAY I’M 40 WILL YOU PEOPLE BE HAPPY.GOOGLE PUTS WRONG INFORMATION ALL THE TIME .. I DON’T EVEN KNOW HOW TO CLARIFY THIS ENOUGH,” NA WETIN SHE WRITE BE DAT.

You fit go read di tori…READ MORE