fbpx
April 28, 2024

UNIZIK lecturer born septuplets

unizik-lecturer-born-septuplets

One UNIZIK lecturer born septuplets. After she born di babies, For three days, di woman just dey unconscious for hospital.

Di woman dey work for di Department of Business Administration. As she born di children, she no know weda na tears of joy she go shed abi na tears of sorrow. This na because she bin no fit pay di medical bill.

For inside chat, her husband yarn say for three days, she bin dey very unconscious, but between yesterday and today, e be like say she get small power, and hin dey hope say her condition go improve.

FOR MORE NEWS:I go vote for Tinubu – Actress Toyin Abraham 

Di hospital charge Ngozi N19million, dem tell her make she pay di money before dem go fit discharge her with di remaining six babies.

But, di woman explain say dem neva pay her salary for di place wey she dey work, and na since she start di work for di institution, December 2020.

Mr. Celestine Uzodike,wey follow pressmen tok on Wednesday, yarn say na normal process dem take employ hin wife as fulltime lecturer for di institution, but e dey sad say she neva collect salary since she start di work.

UNIZIK lecturer born septuplets, You fit go…READ MORE