fbpx
April 28, 2024

I go vote for Tinubu – Actress Toyin Abraham

i-go-vote-for-tinubu-actress-toyin-abraham

One of di Famous Nollywood actress and filmmaker, Toyin Abraham don tok di reason why di All Progressives Congress, APC, presidential candidate, Bola Tinubu go get her vote for di forthcoming election.

Toyin bin dey live interview with popular television talk show, Your View.

For di interview, she tok say she neva formally announce di candidate wey she chose, but she go like vote for Tinubu because she love am.

Di nollywood actress and filmmaker yarn say Tinubu na wonderful man to her people, and she love Asiwaju.

FOR MORE NEWS: Wizkid don show hin second pikin face with Jada P

“I go vote for Tinubu – I dey tok for myself because I love Tinubu for di things wey hin don do for my industry. But I neva decide, I Just dey tell you.” Na wetin Actress Toyin Abraham tok be that.

She say she no go use her own interest lead others, but Tinubu don help her people even when dem no get anything.

She say make everybody choose any presidential candidate wey dem wan vote for.

You go like read di full tori…READ MORE