fbpx
March 28, 2024

Unknown gunmen shuut 3 policemen, change address go heaven for Enugu

0

Unknown gunmen don shuut Three policemen for Enugu State command Agbani, headquarter of Nkanu West Local Government.

Dis incident, happun on Saturday morning for one roundabout near di Agbani Divisional Police station.

U FIT ALSO READ Gunmen kpai Ex-Benue Polytechnic Deputy Rector, LG Information Officer

According to tori we hear say di police officers dey on stop-and-search duty wen dis unknown gunmen sight dem and immediately dey open fire,on dem way con make dem change address go heaven.

Di incident happun less dan 24 hours wen some unknown gunmen kill one former Commissioner of di state and Oji-River Local government’s chairmo, Chief Gabriel Onuzulike and hin elder brother for dia Nkpokolo-Achi hometown.

Daniel Ndukwe,wen bi tok tok persin for di police state command tok say,after di incident happun finish, dem later call dem say Police/Army team don catch two of those gunmen and dey don collect all di weapon wen dey dia hand.

Hin tok say di team collect one AK-47 rifle with two magazines loaded with ammunition, one Toyota Land Cruiser Jeep, oneToyota Camry car and one RAV4 Jeep wen belong to dat persin wen dem kill,

According to tori di two suspects tok say,dem bin enter Oji-River from di neighbouring community of Anambra state, for evening time on 18/11/2022, and na dem attack and kill Gabriel Onuzulike wen bi former Chairmo of Oji-River LGA and Commissioner for Enugu State and hin brother for Nkpokolo-Achi inside Oji-River LGA.

During, di chase of di suspects bi police officers,Daniel tok say many of dem run enter forest.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *