fbpx
May 17, 2024

Veteran Nollywood actor Sir K don kpai

Veteran Yoruba actor, Kamal Adebayo, wey pipol know as Sir Kay, don kpai go join hin ancestors.

Sir kay na di father of skit maker, Abidemi Adebayo, wey pipol know as “Isbae U”

U FIT ALSO READ Kcee – Fake Life dey pay, na hin make me get money

Tori tok say wetin cause di death dem never know am base on say hin family self never disclose am to di general public.

Sir Kay na one kind actor wey dey use funny slang inside all di movies wey hin act.

Di Chairmo of di Lagos State Parks and Garages Management Committee, Musiliu Akinsanya, aka MC Oluomo, confirm di death of di actor on Tuesday through one post for hin Facebook page.

Hin tok say: “It is with a heavy heart that I announce the passing of Alhaji Kamal Adebayo (sir Kay). May Allah grant him eternal peace. R.I.P SIR KAY”.

To read di full tori CLICKHERE