fbpx
May 18, 2024

Viral Cyclist Don Reveal Why Hin Reject Davido Money

Viral-cyclist-reject-Davido-money

Viral cyclist, Emmanuel Myam wey also dey known as Emmiwuks inside recent statement don reveal why hin reject singer Davido money.

Remember say some report tok say one devoted fan bin trend online as hin start to ride bicycle from Benue to Lagos to visit hin idol, Davido.

Davido react to di development as hin tell hin young fan wey don already dey road trip to meet am say make hin go hin house back because hin no presently dey hin own house.

Di young man no gree listen to Davido as hin yarn say hin no go surrender until hin see di singer. In addition, hin tok say hin get gift wey hin go like  present to Davido one on one.

 

FOR MORE NEWS: Destiny Etiko former adopted daughter, Chinenye Eucharia don cause stir as she write note to Destiny

 

However, as singer Davido see am say di fan no dey ready to stop, hin kon ask di cyclist make hin send hin account number, and make hin go house wait for hin return.

Inside recent interview with Legit.ng, di young man finally disclose di strange reason why hin reject Davido money.

Also,as di Viral cyclist reject Davido money, hin reveal say money no be wetin make am  “risk”  di adventure. However, hin keep di door open for di singer to still personally “bless” him if hin so desire.

You fit go read di tori…READ MORE