fbpx
May 18, 2024

Destiny Etiko former adopted daughter, Chinenye Eucharia don cause stir as she write note to Destiny

chinenye-note-to-destiny

Nollywood actress, Destiny Etiko adopted daughter, Chinenye Eucharia don make tongue dey wag as she write birthday note to Destiny.

Remember say e never too tey wey Destiny confirm say she don cut ties with Eucharia, she reveal say di girl do wetin she no like.

Destiny tok am inside video wey she share on top Instagram say she pick, train, and spoil Chinenye, but all di thing wey she received in return na disrespect and a lack of gratitude.

As di matter be so, e be like say di aspiring actress don forget about all di differences between herself and Destiny Etiko and she enter her social media page to wish her happy birthday.

 

FOR MORE NEWS: Plateau United sign three foreign players

 

Chinenye send her best wishes for Destiny despite dia previous disagreement and accusations of disrespect and ingratitude.

She share di heartfelt message with one photo of Destiny and she write;

“Today the world celebrates an icon, beautiful both inside and out. Mami, I pray that the blessings of God continue to shower upon your life as you step into this new age. May you experience abundance and immense happiness. Happy Birthday! Cheers.”

You fit go read di tori see Chinenye note to Destiny…READ MORE