fbpx
May 5, 2024

Vladimir Putin don give warning as hin reveal say ‘Satan II’ hypersonic missile don almost ready

Vladimir-Putin

Russian President, Vladmir Putin don warn say new “Satan II” hypersonic missile go dey ready for deployment soon.

Putin wey vow to provide hin Russian troops with anything wey dem need to win di war for Ukraine, give di terms of strategy as hin invasion of di neighbouring country continues.

Di hypersonic Sarmat missile, Satan II, fit dey added to di Kremlin artillery for di new year.

FOR MORE NEWS: Champions League: Na a must trophy to win – Guardiola

Some pipo think say di Satan II warhead fit carry up to 10 nuclear warheads five times di speed of sound, with a range of 12,000 miles.

For di televised end-of-year meeting with Moscow military chiefs, Putin insist say money no go be barrier to provide troops with di latest weapons.

He criticize NATO too as hin claim say di western leaders dey prolong di conflict as dem dey provide military aid to Ukraine.